Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 34:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Doz wey dey go meet am make E help dem, go happy well-well and shame nor go ever katch dem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 34:5
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.


Nobody wey trust Yu dey si disgrace, but disgrace na for doz wey dey try to deceive odas.


Yu lite one lamp for mi. Na di Oga my God put lite for my darkness.


Pipol wey dey fear God, lite dey shine for dia body and doz wey get pure heart, dey always happy.


bikos na Yu bi di wota wey dey give life; di lite wey make us dey si.


Una go si dis tins kon happy; una go dey happy as una dey waka. Dem go bring all di nashons propaty kom give una. Dem go bring dia money from di oda side of di river kom.


Make evribody for di world turn kom meet mi naw and una go dey save, bikos na mi bi di only God wey dey.


My Oga God, make Yu turn kon ansa mi! Make yu give mi strent again or I go die.


My God, make Yu disgrace dem finish until dem bigin praiz yor name.


Jew pipol kon dey happy well-well and belle sweet dem.


Joab go di king house kon tell am, “Today, yu don disgrace yor men, di men wey save yu, yor shidren, wifes and yor girl-friends.


So David and en six hundred men kon run komot Keilah; dem kon dey go from one place to anoda. Wen dem tell Saul sey David don run komot Keilah, e nor kon go der again.


I dey rest, sleep and wake-up well, bikos God dey protet mi.


Afta, make una koll mi wen una dey trobol and I go kom save una, den una go give mi all di glory.”


But to dey give tanks, na di kind sakrifice wey dey sweet mi for body. So if una follow my kommand, I go show una how God salvashon bi.”


Wen I pray, na wons Yu dey ansa mi! Yu enkourage mi kon give mi strent.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka