2 Na only God name I go take boast; so make doz wey dem dey opress, listin and happy well-well.
If anybody won boast, make e boast sey e know and undastand mi, bikos my love dey forever and I dey do wetin dey korrect and true. I like pipol wey dey do dis kind tin. Mi, wey bi God, don tok.”
bikos, God word sey, “Anybody wey won boast, make e use Christ take boast.”
Make pipol wey dey fear Yu, dey happy wen dem si wetin Yu do for mi, bikos I don put my hope for yor word.
My God, wi go always dey give Yu glory and praiz yor name forever and ever.
But pesin wey won boast, make e boast about di work wey Jesus do.
Dem go bless and praiz Israel pipol, bikos of di Oga awa God.”
Make wi praiz en holy name and wi wey dey woship God, make wi happy.
Bring mi kom out from prison, so dat I go tank Yu. Pipol wey dey fear God go kom gada round mi, bikos Yu dey good to mi.”
Den e sey, “Dem nor born mi with anytin and wen I die, I nor go karry anytin follow body. Na God dey give and E don take. Make wi praiz God name!”