Psalms 31:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English7 I go happy and dance for yor love wey nor dey fail, bikos Yu don si my trobol and Yu kare about di pains wey dey my heart. Uka jalj uñjjattʼäta |
Naw, awa God, di One wey dey great, get pawa and dey mighty, di Pesin wey dey keep en kovenant of love wey nor dey fail, make Yu help us as wi dey sofa. Bikos from di time wey Assyria kings first win us kom rish naw, na sofa wi dey sofa: wi and awa kings, leaders, priests, profets, grand-grand papa dem and all awa pipol.
Una go hear am kon shaut with happiness, with joy and belle go sweet una wen una dey do marriage. Una go hear pipol dey sing as dem dey kom tank mi with dia ofrin. Dem go sey, ‘Make wi tank God wey dey mighty, bikos E good well-well and en love dey forever.’ I go make dis land prosper as e bi before. Mi, wey bi God, don tok.”