6 E make Mount Lebanon dey shake like small animal kon make Mount Hermon dey jump like small melu.
(Sidon pipol dey koll am Hermon Sirion, why Amor pipol dey koll am Senir),
Na God take dem komot from Egypt; E dey fight for dem like wiked melu.
Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.
But Yu don make mi strong like melu wey dey bush and use oil wey fine pass, take anoint mi.