Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 27:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Make Yu nor rijet mi. Nor vex push yor savant komot from yor present, bikos na Yu dey diliver mi. So, make Yu nor leave or abandon mi, bikos na Yu dey fight for mi.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 27:9
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Nor leave yor savant, bikos I dey trobol, but make Yu ansa mi naw-naw!


So, my Oga God, make Yu kwik kom ansa mi, bikos my wahala dey worse evriday. Make Yu nor turn from mi, if not, I go die.


Make Yu nor turn from mi wen I dey trobol. Listin and kwik ansa mi wen I koll Yu.


Make una nor love money and make wetin una get rish una, bikos God sey, “I nor go ever leave or abandon yu.”


I go make kovenant wey nor dey end with dem sey I nor go ever stop to do good tins for dem and I go make dem fear mi with all dia heart, so dat dem nor go turn leave mi again.


Dem go get God blessing kon bi di God wey dey save dem, friend.


I dey do wetin dey rite, so make Yu nor leave mi for doz wey dey opress mi.


My Oga God wey dey save mi. For day time, I dey kry give Yu and I still dey pray to Yu for nite.


Nor drive mi komot from yor present or take yor holy spirit from mi.


Why Yu dey look di oda side? Wetin make Yu do like sey Yu nor know sey wi dey sofa and wiked pipol dey opress us?


My God, Yu go forget mi forever? Na how long Yu go trowey yor face from mi?


Samuel put one stone between Mizpa and Shen. E koll di place Ebeneza, bikos e sey, “Na God help us rish here.”


Dis na wetin God tok: “Una tink sey I drive my pipol komot like man wey drive en wife komot en house? Where di leta wey I take drive una mama? Una tink sey I sell una as slave like man wey sell en shidren? No! Una bi slave, bikos of una sins and dem karry una komot from una land, bikos of di bad-bad tins wey una do.


Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.


Na bikos of una sins make am nor dey hear una. Na una sins dey separate una from God wen una try to woship am.


Make Yu kom near and save mi! Make Yu save mi from my enemies!


Bikos my days dey disappear like smoke and my bones dey hot like wetin fire dey burn.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka