Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 27:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 But where I for dey naw, if to sey I nor bilive sey God go favor mi for dis land wey wi dey?

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 27:13
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den I pray to Yu, my Oga God kon sey, “Na Yu dey guide mi. Na Yu bi evritin wey I really wont for dis life.


So, make wi nor luz hope, bikos even if awa body dey die go small-small, di Pesin wey dey inside us, dey fresh evriday.


But even as I dey fear, I still trust Yu.


Si as yor favor great rish; di one wey Yu keep for doz wey dey fear Yu. Yu dey pour dem on pipol wey kom make Yu protet dem and Yu dey bless dem for evribody front.


Yu don save mi from deat and Yu nor let mi fall at-all, so I go always dey serve Yu, as I dey enjoy dis life.


But wetin make mi nor get mind? Wetin make my heart nor happy at-all? I go put my hope for God hand! I go praiz am again, bikos na-im bi my Savior and my God!


So as wi get dis ministry, just as God don show us mesi, awa hope don strong well-well.


Yu nor fit si wisdom with human being; bikos e nor dey among pipol wey dey alive.


God save una with en grace, bikos una get faith (as una don bilive Christ), nor bi with una own pawa, but na God give una.


Before dis time, I bi like lamb wey dem won go kill, even doh I nor know anytin. I nor know sey na mi dem dey plan dis kind wiked tin for. Dem bin sey, “Make wi kut di tree naw wey e still dey fresh; make wi kill-am, so dat nobody go remember am again.”


I go take am go where dead body dey. I go make una stay for dat undagroun wey empty and na dead body go bi una friend. Bikos of dis, una nor go ever kom out or stay with pipol wey dey alive again.


Na pipol wey dey life fit praiz Yu, just as I dey praiz Yu naw. Papa dem dey tell dia shidren how Yu dey faithful rish.


E dey save pesin life from deat and make am enjoy life again.


I bin tink sey, I nor go ever si God or anybody wey dey alive again for dis world.


But God go distroy yu wons and for all. E go remove yu from yor house kon distroy yu from dis world.


Make Yu hear my prayers, bikos I don taya. Make Yu save mi from pipol wey dey opress mi, bikos dem too strong for mi.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka