Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 26:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 But I nor bi like dat; I dey live betta life. So, make Yu kom save and sorry for mi.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 26:11
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make Yu kom near and save mi! Make Yu save mi from my enemies!


My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart, so make Yu show sey I dey innocent.


As wi dey live with una wey bilive Christ, una and God na awa witness sey, wi dey holy and dey do good tins for God eye without fault.


E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.


Dem dey do wetin God like, dey follow all di tins wey God tok for en word.


“Oga God, make Yu remember sey I dey faithful and loyal as I dey serve Yu. I always dey do wetin Yu wont make I do.” Den e kon bigin kry well-well.


But for mi, God go save my life. E go save mi from deat.


Yet dem nor fit save demsef from deat or pay God for dia life:


E get one man wey dem dey koll Job, e dey stay for Uz land and e dey do wetin God wont. E dey serve God with klean belle and e nor dey do bad tins.


I still provide di wood wey dem go use take burn di ofrin for di rite time and for di first korn and fruit. My God, I beg, make Yu remember mi for good and bless mi.


I give orda sey make Levi pipol go santify demsef, den kon guide di gate to make sure sey dem keep di Sabat Day holy. My Oga God, make Yu still remember mi kon save mi, bikos of yor great love.


My God, make Yu remember all dis tins wey I don do for yor temple and for yor work.


All di govnors wey don rule before mi, trobol di pipol and dey kollect forty silva koins evriday for food and wine. Even dia savants dey opress di pipol too. But I difren from dem, bikos I dey fear God.


Make Yu help mi to do di rite tin, so dat I go dey honest and dey do good as I dey rule my kingdom.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka