Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 26:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Dia hands dirty with di wiked tins wey dem don do and dem dey always take bribe.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 26:10
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make una nor judge anyhow or judge wetin una nor know. Make di judge dem nor take bribe from pipol, bikos bribe dey blind wise pesin eye kon spoil betta pipol mind.


Evriday, na how yu go take distroy pipol yu dey plan. Yor tongue dey kut pipol like razor blade and yu sabi lie well-well.


But en boys nor follow wetin e tish dem, instead dem dey take bribe and nor dey judge well.


“Make una nor take bribe, bikos bribe dey blind pesin eye and spoil good pipol.


Wen morning rish, some Jew pipol kon gada dey make bad plan and dem swear sey dem nor go chop or drink anytin until dem kill Paul.


Dia hand dey only like to do bad tins! Doz wey bi ofisas and judge, na only bribe dem wont. Doz wey get pawa, dey use am get wetin dem wont.


Una sin and all di bad-bad tins wey una do, I know as dem bad rish. Una ponish good pipol; dey take bribe and nor allow poor pipol get korrect judgement for kourt.


Di pesin wey dey do and tok wetin dey rite; wey nor dey shit poor pipol, bikos e get pawa and wey nor dey take bribe, join doz wey kill pipol or join do bad tins,


Wiked pipol nor dey fit sleep until dem do bad tin. Dem nor go gri rest until dem wound pesin.


Bikos dem dey enjoy to do bad tin and dem always dey ready to kill.


Instead of dem to dey sleep for nite, na bad tins dem dey plan. Wetin dem dey do nor dey good. Dem nor even dey try to turn from dia wiked ways.


bikos wiked pipol dey wound innocent pipol anyhow. Dem hide for darkness dey shot good pipol with dia bow and arrow.


But Yu dey si di trobol and wahala wey dem dey kause. Yu dey si evritin; so make Yu ponish dem. Doz wey nor get help dey trust Yu and na Yu dey fight for shidren wey nor get papa and mama.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka