Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 26:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart, so make Yu show sey I dey innocent.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 26:1
30 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na God bi my strent, my guide and I trust am with all my heart. My heart dey happy well-well, bikos God help mi. So, I go always dey sing dey tank am.


Bikos na Yu dey judge evribody, make Yu show sey I dey good, bikos true-true, I dey innocent and na Yu bi di Most High God!


Good pipol dey always do di rite tin and God dey bless dia shidren.


Bikos di king trust God, en love wey nor dey fail, nor go let di king fall.


“My Oga God, make Yu remember sey I don serve Yu with all my mind and I dey always try to do evritin wey Yu wont make I do.” Den e start to kry well-well.


Make God judge di matter kon tok who dey rite and wrong. Make e kom defend and save mi from yu!”


So my brodas and sistas, make una do evritin to show sey, God koll and choose una. As una dey do so, una nor go ever fall inside sin.


and en pawa dey protet am thru faith and wi dey wait for di salvashon wey go kom for di time wen di world go end.


So make wi whole di hope wey wi get strong well-well, bikos God wey promise us dey always keep en promise.


Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.


E dey bad to borda yorsef about wetin pipol dey tink about yu, but if yu trust God, yu go dey save.


E nor go let mi kick stone fall; di Pesin wey dey guide mi nor dey sleep.


But I shaut kon kry sey, “I dey fall” so Oga God wey en love nor dey fail, kom support mi.


Na-im bi my Rock and Salvashon; di place where I dey hide put and I nor go fear or shake.


Na-im bi my Rock and Salvashon; di place where I dey hide put and I nor go fear or shake.


My God, make Yu kom with yor great pawa kon save mi! Make Yu defend mi with yor strent.


My God, make Yu show sey I dey innocent! Save mi from pipol wey nor dey fear Yu. Diliver mi from doz wey dey lie,


Dem don make God law dia own, so dem nor go ever sin.


Show sey I nor do anytin, bikos na Yu dey judge well. Make Yu nor let my enemies laf mi, bikos of di trobol wey I dey face.


But my Oga God, I trust Yu, bikos na Yu bi my God!


But I nor bi like dat; I dey live betta life. So, make Yu kom save and sorry for mi.


As I dey loyal and honest rish, Yu dey protet mi, bikos na Yu bi my hope.


Na only Yu I trust, so make Yu nor let pipol disgrace mi or allow my enemies happy wen I fall.


Na doz wey dey live good life and do wetin dey rite; pipol wey dey tok trut with pure heart.


Make yu offa sakrifice with di rite spirit give God kon trust am.


E dey wosh and guide di pipol wey E choose, but E dey make wiked pipol shut up for di dark place wey dem dey, bikos nobody fit win war with en own pawa.


God ask Satan, “Yu know my pikin wey dem dey koll Job? Nobody bi like am for dis eart; e dey klean and good well-well. E dey do wetin God wont and e nor dey do bad tins. Yu beg mi make I let yu attack am wen e nor do anytin, but e still dey fear mi as before.”


Yu suppose get konfident and hope, bikos yu dey woship and trust God.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka