Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 25:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Make Yu nor remember di sins wey I kommit wen I yong. Remember mi for di lite wey yor love wey nor dey fail dey bring, bikos Yu my God, dey sorry for pesin.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 25:7
25 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But na mi wey bi God still dey forgive una sins and I do all dis tins, bikos of who I bi! I nor go kount una sins against una.


Di pain wey I go thru na for my own good. Yu save my life from all di wahala kon forgive mi my sins.


Yu just dey rite bad tins against mi; even di ones wey I kommit wen I bi small pikin.


So make wi liedan with shame! Make awa disgrace kover us. Wi and awa grand-grand papa don sin against di Oga awa God. Since wi dey yong kon rish naw, wi nor gri obey di Oga awa God.”


My God, make Yu sorry for mi, bikos of yor love where nor dey fail. Make Yu forgive mi my sins, bikos Yu dey sorry for pipol.


I go forgive dem for all di wiked tins wey dem don do and I nor go remember dia sins again.”


My Oga God, make Yu help mi! Make Yu save mi, bikos of yor love wey nor dey fail.


Make Yu nor kount awa grand-grand papa dem sin against us and bikos Yu dey sorry for pipol, make Yu kwik-kwik kom ansa us, bikos e remain small make wi die finish.


Make yor favor shine on yor savant. Make Yu save mi with yor love wey nor dey fail.


Make Yu kom back kon help mi. Save mi bikos of yor love wey nor dey fail.


Dia smooth and betta body, go soon turn to dust.


Afta dis, Jesus kon si di man inside di temple. So e kon tell am, “Look, yu don well naw, make yu nor kommit sin again, oda-wise, di tin wey bad pass wetin do yu before, go happen to yu.”


One man dey der wey nor fit waka for thirty-eight years.


so make Yu nor too vex for us or use awa sins against us forever. Wi bi yor pipol, so make Yu sorry for us.


I bi yor savant, so make Yu show mi yor love wey nor dey fail kon tish mi yor laws.


Bikos e nor gri help oda pipol; e ponish poor pipol, doz wey nor get and e dey trobol doz wey nor get heart, till dem die.


Make God nor ever forget di sins wey en papa kommit; make God always dey remember en mama sins.


Joy dey for pipol wey dey do well and always dey do wetin dey rite.


My God, wen Yu dey show yor favor to yor pipol, make Yu remember mi; make Yu kom near and save mi.


Na bikos of mi, I dey do am. Yes! I dey do all dis tins bikos of mi. I nor go fit let una spoil my name. I nor go let anybody share my glory with mi.


“Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before. Mi, wey bi God, don tok.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka