Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 23:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 E dey make mi strong. E dey guide and take mi pass di rite road, so dat pipol go honor en name.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 23:3
28 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I go lead doz wey nor dey si, pass di road wey dem neva travel pass before. I go turn dia darkness to lite kon make rof road smooth for dem. Dis na wetin I promise and I go do dem; I nor go fail.


Na Yu bi my rock and my guide. Bikos of di honor wey yor name get, make Yu take mi komot from wahala.


God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.


My God, make Yu put betta heart inside mi and make yor spirit strong inside mi too.


My God, make Yu save mi as Yu dey lead mi, bikos my enemies dey korna dey wait to katch mi. Make Yu remove all di problem wey dey di road wey Yu dey take mi pass,


Make Yu give mi back di joy wey make mi dey save, so dat I go dey happy to obey Yu.


E dey save pesin life from deat and make am enjoy life again.


I dey follow korrect judgement and I always dey do wetin dey rite,


I dey korrect and ponish anybody wey I love. So make yu dey sirious kon turn from sin kom meet God!


My God wey dey save us, make Yu kom help us! Make Yu forgive us, bikos of di glory wey dey yor name.


Raitiousness dey go for God front go prepare di way wey E go pass.


I don tish yu wisdom and di korrect way to live yor life.


I dey waka go like sheep wey waka lost for bush, so make Yu kom find mi, bikos I neva forget yor laws.


But I nor distroy dem since dat one fit stop pipol to obey mi, bikos some kountry don si and hear as I take-take Israel pipol komot from Egypt.


Den I ansa, ‘I go bring dem back from nort kon gada dem from evry part for di eart. Doz wey blind; wey nor fit waka; wimen wey get belle and doz wey won born, go follow dem kom back too. Dem go kom back as one great nashon.


So, make all praiz and glory bi en own, bikos of en free grace wey E give us, thru en pikin wey E love well-well.


Kom make wi tok about how God great rish; kom make wi praiz en name togeda.


Drag mi komot from di trap wey my enemies set for mi, bikos na only Yu fit protet mi.


But God still save dem, just to defend di honor for en name and to show en mighty pawa.


My Oga God wey get pawa, make Yu protet mi, bikos of who Yu bi! Den kon save mi, bikos Yu dey faithful and good.


Doz wey don taya, I go give dem wota drink kon feed doz wey don weak bikos of honga.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka