Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 23:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Just as shepad dey guide en sheep, na so too God dey guide and provide for mi; so hongry nor go kill mi.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 23:1
25 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My God go give una evritin wey una nid, bikos of en glory and propaty wey dey inside Jesus Christ.


“Na mi bi di good shepad. Di good shepad ready to die for di sheep.


E go kare for en animals just as shepad dey do. E go gada di lamb togeda kon karry dem for en hand; E go lead and guide dem.


“Na mi bi di good shepad, I know di sheep wey bi my own and dem know mi too.


Bikos di Lamb for di throne, go bi dia Shepad. E go take dem go drink from di river wey dey give life. And evry tears wey dey dia eyes, God go klean am komot.”


But make una first do di good tins wey God wont and evry oda tin go bi una own.


Before-before, una waka komot for di rite road like sheep wey lost, but naw, una don turn back go meet di Shepad and Pesin wey dey guide una soul.


So wen di big shepad, Jesus Christ go kom, e go give una crown wey en glory nor go ever fade.


Oga God na awa sun and naim dey protet us. God dey give us grace and glory and E go always dey good to doz wey dey do good.


True-true, if E let dem kill en own pikin for awa sins, den E go fit give us evritin wey wi ask from am free of sharge!


God wey get peace, di Pesin wey use di everlastin kovenant blood bring awa Oga God Jesus Christ kom back from deat; awa Oga God wey dey look di sheep,


Wen e kom, e go lead di pipol with God strent, pawa and name. Den en pipol go stay for peace, bikos dem go dey honor am for evriwhere for di world.


But E lead en own pipol kom out like many sheep kon guide dem pass di wildaness.


All di nashon, make una hear wetin Oga God won tok, den una go-go tok about am for far land wey dey near di sea sey, “Just as shepad dey guide en sheep, na so too God wey skata en pipol, go gada and guide dem again.


Den, wi yor pipol, di sheep for yor field, go tank Yu forever kon dey praiz yor name from one generashon go rish anoda.


But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.


My shidren, make una kom listin to mi and I go tish una how to fear God.


I go let dem stay for peace for di mountins, valleys and all di fine field.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka