Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 22:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Make doz wey dem dey opress, si food kon chop beleful. Evribody wey dey fine God, go praiz am and dia heart go dey happy with joy wey nor dey end.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 22:26
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So make pipol wey dem dey opress, happy, bikos God go enkourage doz wey dey obey am.


I dey tell una sey, doz wey woship and obey mi, go get plenty food to chop and drink, but food and wota go hongry una wey dey disobey mi. My pipol go dey happy, but na disgrace go follow doz wey dey disobey mi.


But pipol wey dey find Yu, make joy and gladness full dia heart. Make doz wey love yor salvashon always dey shaut sey, “God dey great!”


For Mount Zion, God wey dey lead heaven sojas go do big party for all di pipol for di world. For di party, plenty food go dey to chop and wine go dey to drink; betta meat and sweet wine go dey too.


But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”


Bikos E dey give wota to pipol wey nid am and food to doz wey dey hongry.


For der wey all di pipol gada put, David praiz God kon sey, “God wey awa papa Jakob serve, wi praiz yor name forever!


All di good tins wey Yu do, I nor keep dem for my heart; but I don tok about as Yu dey faithful and yor pawa wey dey save pipol.


So make tanksgivin bi una sakrifice to God, den make una keep di promise wey una make to di Most High.


I go keep my promise wey I make to God for en pipol present.


Na for pipol present I go for do wetin I vow to God


Den God kon kommand di fish make e go vomit Jonah put for dry land.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka