25 I go praiz Yu for where yor pipol gada. Doz wey dey woship Yu, na for dia present I go for do wetin I vow.
Den I go tank Yu for where yor pipol gada put. I go praiz Yu for all yor pipol front.
Make wi Praiz God! I go tank God with all my heart for di pipol front wey dey obey and gada woship am.
I go enter yor temple with sakrifice; I go do di tins wey I promise Yu;
My God, I go do wetin I vow to give Yu and tank Yu, bikos of how Yu dey help mi.
I go tok about yor name for where my kountry pipol dey. I go praiz Yu for where yor pipol gada put.
Kom! All of una wey dey loyal to God, make una listin as I dey tok wetin E do for mi!
My God wey dey Zion, na betta praiz dey wait Yu, bikos yor pipol dey do wetin dem promise.