Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 20:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Make wi shaut for joy wen wi hear viktory sound kon raiz awa banner wey dey show awa God name. Make God ansa all awa prayers.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 20:5
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So Moses build one altar kon koll am, “Na di Oga God bi my banner,”


But Yu don give one banner to pipol wey dey fear Yu, so dat dem go dey save wen enemies attack dem.


Eli kon ansa, “Make yu go! Make peace follow yu and make Israel God give yu wetin yu wont.”


Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.


Wen all dis tins dey happen, pipol go sey, “Look! Make una si God for here! Wi wait for am and E don kom diliver us. Si God for here! Wi really wait for am. So make wi rijoice and dey happy bikos E don save us.”


and my spirit dey happy bikos God, my Savior,


Na songs for joy and viktory dem dey sing for di kamp of pipol wey dey fear and obey God, bikos God don do wonderful tins with en strong rite hand!


Den I go happy, bikos of my God. I go happy, bikos E save mi.


But I trust yor love wey nor dey fail. I go happy, bikos Yu don save mi.


Save mi so dat I go fit praiz Yu for publik for Jerusalem gate. Yes! I go dey happy bikos Yu don save mi.


I go still dey happy and sing for joy, bikos na Oga God dey guide mi.


Even doh di nashons around us dey serve dia juju, wi go woship and obey di Oga awa God forever and ever.


yet dia vois don rish evriwhere for di eart and dia word don pass evriwhere for di world. God don build house for di sun for heaven


Di day dey kom wen di new king from David family go bi sign to all di nashons. Pipol go gada for en royal town; gi-am respet kon ask make e guide dem.


My God, si as di king dey rijoice, bikos of yor pawa! E dey happy and shaut, bikos Yu make am win.


But David ansa am, “Yu dey kom meet mi with swod, spear and javelin. But I dey kom meet yu with di name of di Oga wey bi God of all ogas; Israel sojas God wey yu dey shalenge.


Na suksess and progress Yu take welkom am back kon put one fine gold crown for en head.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka