Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 2:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Den di king sey, “I go tell una wetin God kommand. God tell mi sey: ‘Yu bi my pikin! Today, I don bi yor papa!

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 2:7
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Christ nor praiz ensef wen e bikom High Priest, but na God praiz am wen E sey, “Yu bi my Pikin! Today, I don bikom yor Papa.”


E don do wetin E promise us and dia shidren, wen E raiz Jesus Christ, as dem rite am for Psalms sey, ‘Yu bi my Pikin and today, I don bi yor Papa.’


Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”


As e still dey tok, one brite kloud kon kover dem and one vois kon sey, “Dis na my Pikin wey I love. Make una listin to am!”


I go make am my first-born and bikos I choose am as king, na-im pipol go praiz pass for di whole world.


and naim bi my only Pikin wey I wake-up from deat with di Holy Spirit pawa.


“God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.


Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.


But as God Pikin, Jesus dey faithful for God house. So wi too go get share for di house if wi bilive and get konfident for awa hope wey dey inside Christ.


Nobody don fit si God face before. But Jesus, wey bi God ensef, wey en and en Papa bi tait friend, na-im kom show us how God bi.


Simon Pita ansa, “Yu bi di Mezaya, God Pikin wey dey alive.”


Even doh e bi God Pikin, na thru all di tins wey e sofa, e take learn how to obey.


Di demons kon hala, “God Pikin, make yu leave us o-o, abi yu kom sofa us wen time neva rish?”


I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.


E put dem for where dem dey forever and ever. Nobody fit tok against en kommand.


E neva shange and nobody fit oppoz or stop am from wetin E won do.


As dem dey go, dem kon rish where wota dey, naim di man sey, “Si, wota dey here! Wetin go make mi nor baptize naw?”


I go bi en papa and e go bi my pikin. Wen e do wrong, I go ponish am as papa dey ponish pikin.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka