5 So God kon vex tok to dem and dem bigin fear wen E sey,
E go judge evribody akordin to wetin dem do kon defend doz wey nobody dey help. E go ponish wiked pipol and doz wey dey do bad tins, go die.
One sharp swod dey kom out from en mout and e go take am distroy all di kountries. E go rule dem with strong hand and E go mash di grapes wey dey bring wine with strong vexnashon, bikos na God get all di pawa.
Wen Yu appear, Yu go trow dem put for fire wey dey burn well-well. God go vex distroy dem for di fire.
But doz my enemy wey nor wont make I bi dia king, make una go bring and kill dem for my front!’ ”
but I dey vex for di nashons wey feel sey dem dey save. Bikos as I dey try make I nor vex for my pipol, doz nashons dey make my pipol sofa more-more.
“Make una listin to dat loud nois for di town; dat sound for di temple na di sound wey God take dey ponish en enemies!
E whole seven stars for en rite hand and swod wey get two sharp side, dey kom out from en mout. En face dey shine like sun.
Di king vex well-well kon send en sojas make dem go kill di pipol wey kill en savants and make dem burn evritin for dia town.
But all di pipol wey dey akuiz and tok bad about mi, make God ponish dem with all dis curse.
God dey vex for all di nashons and dia sojas. E go kill and distroy dem.