Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 2:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 But di King wey dey heaven dey laf dem anyhow. Yes! God dey laf dem well-well.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 2:4
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But God just dey laf, bikos E know sey di day to judge dem, don near well-well.


But Oga God, dey laf dem. Yu dey laf all dis wiked nashons.


Na di Pesin wey sidan for di throne, make am. Di One wey dey on-top di eart and high pass di sky. Pipol for groun, small like ants for en eye. E dey stresh di sky like curtain; like tent where pipol dey stay.


So, I go laf una wen una enter trobol kon take una do yeye wen wahala start.


But God dey for en holy temple; E dey rule from heaven. E dey look as evribody dey live dia life for dis eart.


Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.


Awa God dey for heaven and E dey do wetin E like.


Fear go katch dem and na di kind fear wey dem neva si or hear before. God go skata yor enemies bones. God go disgrace dem, bikos E don rijet dem.


God sey, “Heaven na my throne and na di eart I dey put my leg. Wish kind house una go fit build for mi? Wish kind place I go stay?


bikos na en bi di Pesin wey dey di sky from one generashon go rish anoda! Si! Na-im dey make dat loud tonda nois.


And dis na wetin I tok about am: “ ‘ “Zion dota wey neva sleep with anybody before, dey curse and laf yu; Jerusalem dota dey shake head follow yu.


Na Yu bi my strent and I dey wait make Yu save mi! Na Yu God, bi my guide!


My God wey dey heaven, na Yu I dey depend on.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka