Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 2:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave. But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 2:12
30 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make una si as pipol wey trust God dey happy; doz wey nor like proud pipol or woship juju.


so dat evribody go bow down for di pikin as dem dey bow down for di Papa. If anybody nor bow show respet for di pikin, e nor go get di mind to respet di Papa wey send di pikin kom.


My Oga wey bi God for Heaven Sojas, make Yu si di blessing wey dey follow doz wey trust Yu.


Make yu kom try God, den yu go si sey God dey good: Make yu si as God bless di pipol wey bilive am!


But I go bless doz wey trust mi. Pipol wey bilive sey I go save dem.


Bikos of dis, God dey ready to pity for en pipol; E sidan for en throne and E dey ready to forgive una. True-true, God dey good and evribody wey get faith and dey wait am, go happy well-well.


Listin to wetin dem tish yu and yu go dey susesful; make yu trust God, so dat blessing go follow yu.


God word sey, “Naw, I don lay one stone for Zion; di main stone wey I choose; no money fit buy am and anybody wey bilive am, nor go shame.”


so dat wi wey first bilive Christ, go dey gi-am praiz and glory.


But I still get 7,000 pipol for Israel wey dey obey mi and neva serve Baal before.”


God word sey: “Si, for Zion, I dey arrange stones wey go make pipol fall, yet doz wey bilive am, E nor go disappoint dem.”


So God kon vex tok to dem and dem bigin fear wen E sey,


True-true, God dey guide en pipol for evritin wey dem dey do, but E go distroy doz wey nor dey follow en ways.


Den Samuel take one kontaina wey get olive oil kon pour am for Saul head. Samuel kiss am kon sey, “God don choose yu make yu lead en pipol, Israel! Yu go rule and diliver dem from dia enemies wey dey round dem. Dis go bi di sign sey God don choose yu as leader ova en propaty.


Dem still dey sin and woship juju wey dem make kon design am with silva. Dem dey sey, “Make una kom sakrifice and kiss dis juju!”


Den di king sey, “I go tell una wetin God kommand. God tell mi sey: ‘Yu bi my pikin! Today, I don bi yor papa!


Bikos God word sey, “Anybody wey bilive am, nor go shame.”


Jesus ansa am, “Na mi bi di road, di trut and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass thru mi.


True am, una bilive God wey raiz am from deat kon gi-am glory. So, una faith and hope dey for God hand.


Na yu go take kare of my house and all my pipol go obey yor kommand. Na only mi, di king go dey great pass yu.”


Yu dey guide and hide dem for yor present and dia enemies nor go fit tosh dem or lie for dia head.


Una wey bi God pipol, make una fear am, bikos doz wey dey fear am go get evritin wey dem nid.


But all di pipol wey dey akuiz and tok bad about mi, make God ponish dem with all dis curse.


Make una gada before judgement go start; before una time to turn from sin kom meet God go pass, just like wen breeze blow leaf trowey. Make una do di rite tin naw, before God vexnashon go fall on-top una and before en judgement go start.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka