6 Di sun dey kom out from one end for di heavens till e rish di oda end and nor-tin fit hide from en heat.
Di sun dey raiz-up and down, den e go hurry go anoda place where e go for raiz again.
Yu feel sey as di kloud tick rish, God nor go si as E dey waka for heaven?
If true-true una get faith and una leg strong for groun, den una go get hope kon whole di gospel wey una hear. Dem don prish dis gospel give evribody for di world and mi Paul don bi di gospel savant.
Pipol go praiz God name from east go rish west.
Anybody fit kount di angels? Abi e get where God lite nor dey shine rish?
If I sey make I fly as day dey break kon go di oda side for di sea,
My God, make all yor enemies die like Sisera! But make doz wey love Yu, shine like sun!” So peace kon dey for di land for forty years.