Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 18:41 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

41 Wen dem koll pipol to help dem, nobody gri kom. Dem even kry to God, but E nor gri ansa dem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 18:41
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dat time, una go koll mi wey bi wisdom, but I nor go ansa. Una fit go find mi for evriwhere, but una nor go si mi.


Wen trobol go kom, God go hear dia kry?


If di Oga God wey get di house go lock di door, una go stand for outside dey nok and beg sey, ‘Oga God, make yu let us enter!’ “But e go ansa, ‘I nor know where una from kom.’


“Bikos dem nor gri listin wen I tok to dem, na so too I nor go listin anytime wey dem pray to mi.


But wen una dey trobol, una go kom beg God make E help una! Una dey espect sey God go ansa una? Afta all di wiked tins wey una don do, God nor go even look una face!”


Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.


So, dem go feel my strong vexnashon. I nor go sorry or pity for dem. Dem go shaut well-well as dem dey pray give mi, but I nor go ansa or listin to dem.”


Even if dem fast, I nor go listin to dia kry for help and if dem offa burnt and korn ofrin, I nor go asept am. Instead I go kill dem for war and with diziz and honga.”


So, mi wey bi God sey: ‘I go soon distroy dem and dem nor go fit eskape. I nor go listin to dem wen dem kry kom meet mi for help.’


Wen una raiz una hand dey pray, I nor go look una. Even if una pray many prayers, I nor go listin, bikos blood don stain una hand.


All of una wey don forget mi, make una turn from sin kom meet mi or I go kill una finish and nobody go kom help una.


Den Joshua kill di kings kon hang dem on-top tree. Dem dey di tree till evening.


Wiked nashons gada around mi, but I distroy all of dem with God pawa.


Yes! Dem gada round kon attack mi, but I distroy all of dem with God mighty pawa.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka