31 Na who bi God escept God? Na who again bi Solid Rock escept awa God?
Bikos awa enemies rock nor bi like awa Rock and even awa enemies know sey na so e bi.
My God, no oda god bi like Yu. No one fit do wetin Yu dey do!
Na mi bi God, no oda god dey wey bi like mi. I give una pawa, even doh una nor know mi well.
Na di Oga bi God and na only God dey defend us.
God sey, “Na Mi, bi Mi! And e nor get any oda god escept Mi. I dey kill and give life, I dey make pesin sick and heal pesin too and nobody go fit fight mi.
Nobody dey holy like God! E nor get anybody wey strong like Yu! E nor get any rock wey bi like God.
So Oga God, wi know sey Yu go protet doz wey dem dey opress. Yu go guide dem forever from doz pipol wey sabi lie well-well,
“Evritin wey God tok, dey korrect. E dey guide evribody wey kom meet am make E protet dem.
Una wey bi Israel pipol dey sey, ‘God dey play wayo.’ Una tink sey na wayo I dey do? Nor bi una dey do wayo?