Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 18:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 With yor pawa, I fit kill many sojas. With my God wey dey my side, I fit jump pass any wall.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 18:29
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Yu give mi pawa take attack my enemies kon ovakom dem.


Bikos I bear rish di end kon follow my Papa sidan for en throne, anybody wey fit bear rish di end, go follow mi sidan for my throne too.


God disgrace wiked and evil rulers for publik, wen E win dem for di cross.


But God kind! I bi wetin I bi and God mesi for mi, nor bi yeye tin. I dey work pass any oda apostle; aldo na God grace dey help mi.


Bikos Yu don give yor kings viktory kon save yor savant David from en enemies swod.


I go praiz God wey bi my rock, bikos na-im dey protet mi. Na-im train my hand for war kon give mi pawa to fight.


David do wetin God kommand and e drive Filistia pipol from Gibeah go rish Geza.


So David ask God, “Make I go kill all dis Filistia pipol?” God ansa David, “Make yu go kill Filistia pipol kon diliver Keilah pipol.”


So David ask God, “Make wi porshu dem? Wi go katch dem?” God ansa, “Make una porshu dem, una go true-true katch dem kon diliver una wifes and shidren.”


David put en hand inside di bag kon take one stone. E put am for di katapault kon shot di Filistia man for en head. Di stone enter en fore head well-well and e kon fall face groun.


Dat time, God always dey with mi and E dey give mi lite wen I dey waka for darkness.


Na God bi my lite and my salvashon, so na who I go kon dey fear? Na en dey guide and protet mi from danger, so wetin go make mi dey shake?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka