2 Show sey I dey innocent, bikos Yu dey si doz wey dey rite.
E go show sey yu dey innocent kon defend yu for publik.
Una wey bi Israel pipol dey sey, ‘God dey play wayo.’ Una tink sey na wayo I dey do? Nor bi una dey do wayo?
“Den una sey, ‘God dey play wayo.’ Naw, Israel pipol, make una ansa mi, ‘I dey play wayo?’
Naw, make all glory bi God own, bikos E nor let una fall and E go bring una kom en present with betta joy wey nor get fault.
But Israel pipol, una sey wetin I do, nor good. So I go judge una with wetin una dey do.”
“With all dis, yor pipol dey sey wetin I dey do nor dey rite. No! Na dia ways nor dey rite.
But God nor go let wiked pipol win or let dem kondemn doz wey dey fear am.