Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 16:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 My God, na Yu dey make mi strong and prosper; Yu don give mi betta future.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 16:5
28 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My body fit fail and my spirit fit weak, but na God dey make my heart strong; na-im bi my own forever.


Den I pray to Yu, my Oga God kon sey, “Na Yu dey guide mi. Na Yu bi evritin wey I really wont for dis life.


I tell mysef sey, “Na only God I get, so I go trust only en.”


E dey give mi food to chop for my enemies present. E pour oil for my head and my cup kon full dey trowey.


Na Oga God dey guide and save mi! So I promise to always dey obey yor word!


Na God get di pipol for Israel; na Jakob bi en special propaty.


‘I go make en shidren-shidren king forever; dem go sidan for di throne from naw go rish wen di world go end.’ ”


Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin and E don choose Israel as en own pipol. En name na God wey dey mighty.”


So, I go honor and put am for where great men dey, bikos na only en sakrifice en life and dem si am as sina too. E karry evribody sins for en head kon pray so dat God go forgive us.


I go dance bikos E diliver mi kon praiz God name forever.


Naw, yor judgement don favor mi and Yu don judge well from yor throne.


But God don promote am sey make e sidan for en rite hand kon gi-am big pozishon as Oga God and di Pesin wey go save di world, so dat Israel shidren go turn from dia sin kom meet God make e forgive dem.


God promise David di kind promise wey nor go shange sey: “I go put one among yor shidren for di throne.


“I don choose my king for Zion wey bi my holy hill.”


Christ go rule until e don put all en enemies under en pawa


Wiked pipol nor go rule pipol wey dey fear and obey God, if not, doz wey dey obey God fit start to do bad tins too.


E go burn wiked pipol with shako, sulfur and fire kon distroy dem with strong breeze.


Make una nor dey drink strong drink, bikos e go distroy una. But make una allow God Spirit fill una mind.


God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.


God don raiz dis Jesus Christ up and evribody si am.


Dem nor get any land for diasef for Israel. Na God bi dia propaty, just as E don tell dem.


Na God make Jordan River as boundary between wi and una (Reuben and Gad tribe). So una nor get rite to woship God.’ And if e happen like dat, una shidren-shidren fit make awa own stop to woship and obey God.


but na to remind us and una and awa shidren-shidren sey, wi go woship God for en present with burn ofrin, sakrifice and peace ofrin. Den, tumoro una shidren-shidren nor go fit tell awa own sey, ‘Una nor get rite to woship God.’


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka