Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 149:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Make una dance praiz en name with sheke-sheke and jita,

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 149:3
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den di yong wimen go sing with joy, while di yong and old men, go dey happy. I go konfort dem kon turn dia kry to joy and dia sorrow go bi happiness.


Make una sing and play sheke-sheke. Make una use jita and harp play sweet music.


Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance.


Naw, Yu don turn my sorrow to happiness. Yu remove di klot wey I take dey mourn kon wear joy for my body like klot,


As dem bring di box kom di town, Mikal wey bi Saul girl pikin look from window and e si David as e dey dance well-well with only linen klot, di woman kon dey shame, bikos of David, en husband.


David wey wear only linen for en waist, dance well-well to take honor God.


Wen Jeftah rish en house for Mizpa, en only pikin wey e get for en life, run kom out kon meet am, dey dance and play tamborin with happiness.


Make una praiz God with di sweet sound from jita; make una use harp take sing to am.


Wen di men start di temple foundashon, di priests wear dia garment, stand for dia pozishon kon hold dia trumpet for hand. Levi pipol wey kom from Asaf family still stand der too with dia cymbals. Dem praiz God akordin to wetin dem rite down for King David time.


Na Heman and Jedutun dey kontrol how dem dey play di trumpets, cymbals and di oda tins wey dem take dey praiz God. Na Jedutun sons dey guide di gate.


Di king follow di advise wey God give King David thru Profet Gad and Profet Natan. E put Levi pipol for di temple with harp and cymbals.


Na dia papa dey lead dem and dem dey sing for God Temple, dey play cymbal and oda instrument as dem dey serve for der. But na di king dey supavise Asaf, Jedutun and Heman.


Dem enter Jerusalem with trumpet and oda tins wey dem take dey sing kon dey happy and dance go God Temple.


Make una blow ram horn wons new moon or full moon festival start!


So di pipol go blow trumpet kon sing sey, “Na Jerusalem bi di hope wey wi get!”


I go build una again and una go take una sheke-sheke kon dance and dey happy again.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka