14 E don make en pipol strong kon honor pipol wey dey obey am and na dem bi Israel pipol wey dey klose to am. So make wi praiz God!
God sey, “I go distroy wiked pipol with dia pawa kon give viktory to pipol wey dey fear mi.”
And e prish peace to una wey dey far and near,
In-short, e nor get any oda kountry wey dia gods dey klose to dem like di Oga awa God wey dey ansa wen ever wi koll am.
Hannah kon pray dey sey, “My heart dey happy bikos of God; I dey blow my trumpet loud for God. I dey shaut and happy, bikos God don disgrace and save mi from my enemies.
But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.
Na only en bi God; di only one wey wi go dey praiz; di Pesin wey don do many wonderful mirakles wey una don si with una own eyes.
Dem dey share and give wetin dem get to poor pipol for free. Pipol go always remember dia good work forever. Dis kind pipol, go get respet and honor.
But thru Jesus Christ blood, una wey bin dey far, God don draw una near ensef,
and dem dey judge dem just as dem rite am. God go fight for evribody wey dey serve am! So make wi praiz di Oga wey bi awa God!
So, una nor go bi strenja and pipol wey nor get share for Israel blessings again, but una go bi God shidren with all di pipol wey dey en house.
Na-im bi di lite wey go show Gentile pipol road kon bring honor to yor pipol, Israel.”
E don remove rulers from dia throne and pipol wey bring demsef down, E don karry dem go up.
My God, make Yu heal mi and I go strong again; save mi and I go dey save, bikos na Yu I dey praiz.
So Oga God, all yor works go tank Yu and di pipol wey bilive Yu, go praiz Yu.
But Yu don make mi strong like melu wey dey bush and use oil wey fine pass, take anoint mi.
Na Yu bi dia strent and glory and e dey sweet Yu to make us strong and bikos Yu favor us, wi dey always win.
Yes! Awa proteshon dey kom from God and na en wey bi di Holy One for Israel, bi awa king.