Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 147:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 God dey support pipol wey nor dey karry body up, but E dey kill wiked pipol trowey.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 147:6
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Doz wey dey honbol, E dey help dem do wetin dey rite, bikos E dey tish dem en ways.


Make una put una body for groun bikos of God and wen di rite time rish, E go karry una up.


If una put una body down for God, E go karry una go up.


Una wey dey honbol, make una ask make God bless and help una to follow en kommand. Make una do wetin dey rite and live betta life. May bi God go protet and save una from en vexnashon, wen E won distroy di world.


E dey karry weak pipol komot from san-san and dey make poor pipol sidan with prince and princess kon put dem for where pipol go honor dem. Di foundashon wey di eart sidan put, na God get am; na on-top am E build di world.


Instead make e show sey Christ dey inside una and una don get gentol and kwayet spirit wey God go value.


God go bless una wey nor dey karry body up, una go enjoy en promise for dis world.


bikos God like en pipol and doz wey honbol demsef, E dey make dem win.


God dey help pipol wey don fall kon support doz wey dia load too heavy to karry.


But Yu, my Oga God! Yu go send wiked pipol go di pit where distroshon dey. Doz wey dey kill pipol and doz wey dey lie, go kwik die, but as for mi, I go trust di Oga, wey bi my God.


Doz wey dey honbol, go inherit di land and dem go get peace kon prosper.


So make una praiz di Oga wey bi Israel God, bikos E dey alive forever and ever. Amen!


Den for di day wen I go do all dis tins, una go mash wiked pipol for groun and dem go bi like ashes under una leg.” Dis na wetin Oga God tok.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka