Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 146:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Make yu nor trust pipol wey get pawa; bikos dem nor go fit help yu.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 146:3
11 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So make una stop to trust human being, bikos dem just dey breath thru dia nose. Wetin dis pipol bi sef? So make una stop to trust human being pawa. All of dem go die one day, so how dem won take help una?


Abeg, make Yu help us fight awa enemies, bikos human being help, dey yuzles


e kon sey, “Make una tell di king: ‘Dis na wetin God tok: “Make una nor fear bikos of all di tins wey una hear and di curse wey Assyria king savant curse mi.


Egypt pipol nor bi god! Dem bi ordinary human being. Dia horse na just flesh nor bi spirit! God go distroy dem with en hand. Di pipol wey dey help dem, go stagga and di ones wey dem dey help, go fall for groun and all of dem go die togeda.


Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.


Abeg, make Yu help us fight awa enemies, bikos human being help dey yuzles.


Di king ansa, “No! If God nor help una, na how I won take help una? I fit give una korn wen korn nor dey? Abi I fit give una wine wey I nor get?”


For dat time, Profet Hanani visit King Asa for Judah kon tell am: “Bikos yu bilive Siria king pass God, yu nor go fit win Siria sojas again.


“For dat time, di peg wey bin dey der before, go fall for groun, den evritin wey hang on am, go skata.” God, wey dey lead heaven sojas, don tok.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka