1 I go praiz God wey bi my rock, bikos na-im dey protet mi. Na-im train my hand for war kon give mi pawa to fight.
E train my hand, so dat I go fit fight war kon bend even di bow wey strong pass.
Na God bi di rock wey dey protet mi. Na-im dey guide mi and na-im bi di pawa wey dey save mi and I dey save inside am.
E dey train mi for war, so dat I go use di bow wey strong well-well.
Di tins wey wi take dey fight, nor bi dis world own, but na God make am strong, so dat wi go fit skata all di strong place where wiked pipol dey. Wi dey skata trobol;
Dem go sey, ‘Yes! Na only God get pawa to save pipol and anybody wey hate am, na disgrace go follow dem.’
But with awa God help, wi go get viktory, bikos E go help us mash awa enemies for groun kon win dem.
Na who bi God escept God? Na who again bi Solid Rock escept awa God?
Kom make wi sing praiz God! Make wi shaut praiz di Rock wey dey save us.
Make Yu bi my Savior and di Rock where I go always hide put. Give kommand make dem save mi, bikos Yu bi my rock and di place where I dey hide put.
Make wi always dey trust God and E go protet us forever.
Den Elisha tell Israel king, “Target with di bow.” Di king kon do am. Den Elisha put en hand on-top di king hand
I koll God wey get all di praiz and E save mi from my enemies.
My God, Yu don give mi wetin go protet mi. Yor rite hand dey support mi and I don dey strong, bikos of di way wey Yu dey help mi.