9 Oga God, make Yu save mi from my enemies; bikos I run kom meet Yu make Yu hide mi.
God name na strong place to hide put, raitious pipol dey run enter and dem dey-dey save.
Den I pray to Yu, my Oga God kon sey, “Na Yu dey guide mi. Na Yu bi evritin wey I really wont for dis life.
My God, make Yu save mi from my enemies. Make Yu protet mi from di pipol wey won kill mi.
My enemies go run wen I koll Yu for help, bikos I know sey God dey for my side!
My future dey yor hand. Make Yu save mi from my enemies pawa, bikos dem won kill mi.
God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.
I kry to di Most High; di God wey dey supply evritin wey I wont
Bring mi kom out from prison, so dat I go tank Yu. Pipol wey dey fear God go kom gada round mi, bikos Yu dey good to mi.”