4 I nor get hope again and fear don break my body finish.
Wen I nor get pawa again, na-im dey protet mi as I dey waka. Bikos anywhere wey I dey go, my enemies don set trap dey wait for mi.
Wen ever I tink of God, na kry I always dey kry make E kom help mi.
Bikos Jesus dey struggol well-well for mind, e pray sotey en sweat kon bi like blood.
River for don kover us; wota for don karry us go.
My God, make Yu hear my prayer! Make Yu listin to my kry for help!
From di end of di eart, I kry kom meet Yu for help, bikos trobol don make my heart heavy. Karry mi go di high mountin, where I go for dey save.
I just dey fear dey shake anyhow and I nor fit stop to shake.
Make Yu turn kon sorry for mi, bikos na only mi dey and I dey sofa well-well.
Yu go gambol for di pipol wey nor get papa again. Bikos of money, yu go sell yor friends wey like yu well-well.
wen betta song with joy full my nite. But naw, I dey look my life kon dey tink and si how e dey difren.
I dey look for di rite pesin wey go kom help mi, but nobody dey even tink go my side! Nobody to help mi; nobody even kare about wetin go happen to mi.