So dis na wetin I tok about God: “Na only en bi di place where I dey hide put, where wiked pipol nor go for fit tosh mi; na-im bi my God and I trust am well-well.”
Look, di time dey kom and e don even rish, wen una go skata and evribody go-go en own way and I go stay alone. But I nor dey alone, bikos my Papa dey with mi.
Den I tink of all di wiked tins wey dey happen for dis world. I si pipol wey dem dey opress, dey kry and nobody dey to help dem. Nobody dey to save dem from doz pawaful men wey dey opress dem.