Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 141:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Make pipol wey dey fear God beat and korrect mi with love! Make my head nor rijet good oil! True-true, even with all dia wiked plans, my prayers dey make dem fear.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 141:5
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

E betta make wise pesin korrect yu dan make fool praiz yu.


I dey korrect and ponish anybody wey I love. So make yu dey sirious kon turn from sin kom meet God!


My brodas and sistas, if una si pesin dey sin, make una wey dey spiritual, koll am back. But make una wosh unasef, so dat una nor go fall inside temptashon too.


Wen wise pesin advise pesin wey ready to listin, wetin e tok, betta pass fine gold ring or necklace.


E good make dem ponish who dey karry body up, so dat pipol wey nor know anytin, go get sense. As wise pesin, yu go get more wisdom wen yu take korreshon.


Na only fool nor dey listin to en mama and papa word; but anybody wey dey take korreshon, go get sense.


As e dey tok, King Amazaya kon tell am, “Na who choose yu to advise di king? Make yu stop to profesai or dem go kill yu trowey!” Di profet stop kon sey, “I know sey God one distroy yu, bikos of dis tins wey yu do and yu nor gri listin to my advise.”


Wetin dem sey make yu do, bi like lite and dia korreshon go fit tish yu how to live yor life.


My God, make Yu do good to pipol wey dey good; doz wey dia heart and mind dey with Yu,


My God, make Yu look Zion with favor kon help am; make Yu ribuild Jerusalem walls again.


E dey give mi food to chop for my enemies present. E pour oil for my head and my cup kon full dey trowey.


But I tell una naw sey, ‘Make una love una enemies and pray for pipol wey dey sofa una’,


Plans dey spoil wen good advise nor dey; but many advise dey bring progress.


Make una nor keep malice with anybody, but make una setol una kworel with dat pesin, so dat una nor go sin, bikos of dat pesin.


Pesin wey dey happy wen dem korrect am, get wisdom, but anybody wey dey vex wen dem korrect am, nor get sense.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka