Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 140:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 True-true, pipol wey dey do wetin dey rite, dey praiz yor name and doz wey dey fear God, go stay for en present.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 140:13
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So make una tell innocent pipol sey e go betta for dem, bikos God go reward dem for wetin dem don do.


Yu don show mi di way wey dey give life kon give mi joy for yor present and I dey happy to stay with Yu forever.


God dey good and E dey judge well; so E go favor doz wey dey do good too.


God go karry wi wey remain for dis world go meet dem for sky, den all of us go-go meet Christ for heaven.


Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.


Wen I don finish, I go kom take una, so dat una go stay with mi for where I dey.


So make evribody wey dey fear God, happy kon praiz en holy name!


Yu dey guide and advise mi as Yu dey lead mi enter where glory dey.


So, doz of una wey get pure heart and dey raitious, make una happy well-well!


True-true, en goodness and love wey nor dey fail go dey follow mi till I die and I go dey for God house forever and ever.


E nor dey give wiked pipol long life, but E dey judge well for poor pipol.


I go praiz God with all di bones wey dey my body kon sey: “Na who I wont take kompare with my Oga God? Na who go fit save pipol wey nor strong from pipol wey strong? Na who go fit protet pipol wey nor get help and poor pipol from tif?”


bikos God go judge dia kase for dem kon ponish doz wey dey treaten dia life.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka