8 If I run go heaven, Yu dey der; if I die go grave, Yu dey der too.
E sey, “I kry give Yu wen I dey wahala and Yu ansa mi. Naw, I dey kry to Yu from where dead body dey, so make Yu go kom help mi and hear my prayers.
But even if una fly like eagle or build una house among di stars, I go bring una kom down!” Na so mi, God, tok.
Even Deat and Distroshon nor get sekret for where God dey, tok-less of human being heart!
Where dead body dey stay just dey open before God; nor-tin fit kover am from en eye.
E nor get where pesin go hide put make I for nor si am. Yu nor know sey I dey evriwhere for di heavens and di eart?