Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 137:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land. Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun! Skata di town rish groun!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 137:7
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Yu go save yor pipol and di king wey Yu choose. Na Yu kill di pesin wey dey lead wiked pipol kon distroy doz wey dey follow am.


God sey, “Edom pipol don too sin, so I go ponish dem naw, bikos dem kill Israel pipol wey bi dia own brodas and dem nor sorry for dem at-all. Dem vex kill dem anyhow and dem nor dey taya.


“Man pikin, make yu tok against Edom.


Dem nor know sey, I remember all di bad-bad tins wey dem do. Dia sin plenty well-well and I dey si all di wiked tins wey dem dey do.


My God, si as di enemies dey curse Yu. Pipol wey nor get sense nor dey respet yor name.


Dis na wetin God wey dey heaven dey tok: ‘I si as Amalek pipol dey trobol Israel pipol, wen dem dey kom out from Egypt.


Den God tell Moses, “Make yu rite dis tin for groun, so dat pipol go remember am, den tell Joshua sey, mi wey bi Oga God go make sure sey Amalek pipol nor go dey dis world again.”


I kon pray, “My God, remember wetin Sanballat and Tobaya dey do, den make Yu ponish dem. Remember and ponish dat woman Noadaya and all di oda profets wey dey won make mi fear.”


just as una dey happy wen Israel skata; Israel land wey bi my own. Mount Seir pipol and all of una for Edom go die finish. Den evribody go know sey na mi bi God.’ ”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka