“For dat day, na kry and mourning nois go bi di song wey dem go dey sing for di palis. Dead body go dey evriwhere and evribody go kwayet as dem dey go beri dem.”
Dem nor go fit offa wine ofrin or sakrifice give God for der. Oga God nor go asept any of una sakrifice bikos e go bi like food wey dem offa give dead body and doz wey chop am, nor go dey klean. Una go only dey chop am bikos of honga, but make una nor bring any one kom God temple.
Den una go tell unasef sey, ‘Who give us all dis shidren? Wi know sey dem kill awa shidren kon karry di rest go as slave. Na only wi dey, so where all dis shidren from kom? Na who born dis shidren? Who train dem for us?’ ”