Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 135:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 E good make evribody for Zion, praiz God and bikos na en bi God wey dey Jerusalem, make all of us, praiz am!

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 135:21
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make God wey kreate heaven and eart bless una from Zion!


Make evribody wey dey for Zion shaut and sing! Bikos Israel God dey holy and great and E dey stay with wi wey bi en pipol.”


Make God always dey bless yu from Zion. As long as yu dey alive, yu go si Jerusalem dey prosper.


Na Jerusalem E dey stay and na Mount Zion bi en house.


But naw, I don choose Jerusalem as di place where I go stay and I don choose David make e lead my pipol.’


My God, as wi dey woship for yor temple, wi go always dey tok about yor love wey nor dey fail.


Si as awa God great rish! Wi go praiz am for en own town wey dey on-top en holy mountin!


Wahala nor go happen to Jakob shidren; Israel pipol nor go si trobol. Bikos di Oga wey bi dia God dey with dem and na-im bi di king.


Den David sey, “Di Oga wey bi Israel God don give en pipol rest and E go stay Jerusalem forever.


Make yu still take all di gold and silva wey yu fit kollect from Babilon and di ofrin wey Israel pipol and dia priests give for dia Oga God Temple for Jerusalem.


Di mountin dey high and fine well-well; di whole eart dey happy to si am! Mount Zion wey bi di holy mountin, na-im bi di town where di great King dey stay!


God ensef dey for Jerusalem towa and na-im dey defend us.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka