Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 132:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 God promise David di kind promise wey nor go shange sey: “I go put one among yor shidren for di throne.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 132:11
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen yu die and yu don go join yor grand-grand papa, I go make one among yor shidren king and I go make en kingdom strong.


God don promise and E nor go break di vow wen E make sey: “Yu bi priest forever like Melkizedek.”


Wi know sey en na profet, bikos God don promise am sey, naim pikin dem go always bi king for Israel.


My Oga wey bi Israel God, make Yu do wetin Yu promise yor savant, my papa David, wen Yu sey, ‘Na yor shidren and shidren-shidren go dey rule for Israel, so-far dem do wetin I tok kon obey my laws, just as Yu obey mi.’


God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.


E go big well-well and dem go koll am God wey dey for heaven pikin and God go gi-am en papa David throne.


E go dey forever like di moon and di sky go bi witness to show how I really dey faithful!”


Yes! I don promise David and bikos I dey holy, I nor go fit lie:


But I nor go stop to love am or forget di promise wey I make with am.


And naw, my Oga! Yu wey bi Israel pipol God, I dey pray make Yu do all di oda tins wey Yu promise my papa wen Yu sey, na only en shidren-shidren go bi king for Israel, as long as dem obey Yu, just as dia papa, David obey Yu.


En house and kingdom go dey before mi forever; en family go rule forever.’ ”


I go bi en papa and e go bi my pikin. Wen e do wrong, I go ponish am as papa dey ponish pikin.


God wey get Israel must do wetin E tok and E nor dey shange en mind, bikos E nor bi human being wey dey shange mind.”


God nor bi like man wey dey lie and E nor bi human being wey dey shange en mind. Anytin wey E promise, E dey do am; Anytin wey E tok, na so e go bi.


kon pray sey, ‘Make wi praiz di Oga wey bi Israel pipol God, wey don make one of my pikin take my place as king and E make mi dey alive to si am!’ ”


Den I go make yor shidren rule forever, just as I promise yor papa David sey, ‘Yu go always get pikin wey go rule ova my pipol, Israel.’


So my God, heavens go praiz di great and wonderful tins wey Yu don do and angels go praiz Yu bikos of how Yu dey good.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka