Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 130:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 So, I put my hope for God hand, I trust am with my whole life and I dey wait for en word wey nor dey fail.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 130:5
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na God bi awa hope. Na-im dey help and guide us.


Bikos of dis, God dey ready to pity for en pipol; E sidan for en throne and E dey ready to forgive una. True-true, God dey good and evribody wey get faith and dey wait am, go happy well-well.


I taya as I dey wait make Yu save mi, but I don put my hope for yor word.


But my soul and body dey kwayet dey wait for God, bikos na-im dey make my heart strong.


I dey kwayet dey wait, bikos na God dey diliver mi.


I wait with patient make God kon help mi, and E turn kon hear my kry.


So, make yu dey patient, as yu dey wait for God and get strong mind. Yes! Make yu dey patient, as yu dey wait for am.


I go really wait for God wey don rijet Jakob family; I go wait for am.


Make pipol wey dey fear Yu, dey happy wen dem si wetin Yu do for mi, bikos I don put my hope for yor word.


Na Yu bi my proteshon and guide and na yor word dey give mi hope.


My Oga God, I trust Yu sey, Yu go save mi!


Make Yu remember di promise wey Yu make give mi, bikos na-im bi my only hope.


My Oga God! Wi dey wait for Yu as Yu dey judge us. Yes! Na yor greatness and as Yu dey do yor tins, dey make us grow.


Den I go fit ansa pipol wey dey won kill mi, bikos I trust yor word.


God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.


For dat time, e kom meet Josef, Mary, di pikin and Simeon kon bigin tank God, dey tok about di pikin give evribody wey dey wait for di time wen God go free Jerusalem.


One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka