2 Even doh enemies dey attack us since wi dey small kom rish naw, dem neva ever fit win us.
And I tell yu, yu bi Pita, wey mean rock and on-top dis rock, I go build my church and di gate for hell nor go fit skata am.
Pipol wey dey do wetin dey rite, dey face trobol well-well, but God go save dem from all dia wahala.
“I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”
Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion; nobody go fit bend dem and dem go dey forever.
My enemies try well-well to kill mi, but di Oga my God save mi.
My God, just as deer dey find wota to drink, na so too I dey find Yu.
E go save yu from trobol six times and wen e rish di sevent one, evil pipol nor go fit tosh yu.
So dem kon dey sofa and ponish Israel pipol. Na Israel pipol build Pitom and Rameses as di place wey Fero go dey keep tins put.