Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 128:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Yor wife go bi like vineyard wey get betta fruit and e go prosper for yor house. Yor shidren go bi like yong olive tree.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 128:3
11 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Yor mama bi like vine wey dem plant near wota wey get fresh leaf and dey bear good fruits.


But I bi like olive tree wey dey grow well inside God house. I go always trust God love wey nor dey fail.


Una wey bi Gentile pipol bi like olive tree branches wey dem kut for bush kon go put for anoda betta olive tree (and e nor suppose bi like dat). Na Jew pipol bi di betta olive tree; so e go eazy for God to join dem back to di original tree again.


Josef na betta vine wey dey produce good food; betta vine wey dem plant near wota and en branches dem dey klimb di wall.


I don first koll una olive tree wey get many fine fruit and leaf. But naw, I go kom like tonda kon put fire and e go burn di leaf, den break di branches dem.


Make awa sons prosper for dia yong age like betta plant wey dem put fertaliza. Make awa dotas bi like betta pila wey dem karve for palis.


Na dem bi di main rizin wey make man dey happy and shame nor go katch di man even wen e meet en enemies for di town gate.


Ulam sons na strong sojas. En shidren with en grand-shidren, na 150 dem bi. Na dis pipol bi Benjamin shidren-shidren.


Yes! Shidren na God gift; dem bi reward from awa Oga God.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka