Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 127:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Yes! Shidren na God gift; dem bi reward from awa Oga God.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 127:3
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God go bless una shidren and una plants. E go still bless una animals and dia pikin wey dem go born.


I ask am for pikin and E don give mi wetin I wont.


Si, mi and di sons wey God give mi, go bi signs and wonders for Israel pipol and na Oga God, di Pesin wey dey stay for Mount Zion, send us kom.


E tell mi sey, ‘I go make yu get shidren and propaty and dem go many well-well. I go make many nashons kom from yu and I go give dis land to yor shidren-shidren as dia own forever.’


Wen Esau si di wimen and dia shidren, e kon ask, “Na who bi dis pipol wey dey with yu?” Jakob ansa, “Na di shidren wey God don give mi, yor savant.”


God bless dem kon sey, “Make una born many shidren full di eart and na una go kare for evritin! Na una bi oga ova di birds for di sky, di fish dem for sea and evritin wey God kreate.”


Dem bless Rebekah kon sey: “Awa sista, yu go bi mama to tazon-tazon pipol! Yor shidren-shidren pawa go strong pass dia enemies own.”


E give mi many sons and na Solomon E choose from all of dem, make e rule God pipol for Israel.


Dem go use dia bows and arrows kill di yong men and dem nor go pity for small shidren or new born baby.


Adam sleep with Eve en wife and e get belle kon born boy, den e sey, “I don get boy just as di Oga God wont!” So e koll am, “Kain.”


God go make una shidren, animal and plant many kon make una prosper for di land wey E promise una grand-grand papa sey, E go give una.


E get thirty sons and thirty dotas. E make en girls shidren marry men from outside en town and en boys shidren marry dia wife from anoda town too. Ibzan rule Israel pipol for seven years.


Itream, wey en mama name na Eglah. Dem born all dis shidren give David for Hebron.


Ulam sons na strong sojas. En shidren with en grand-shidren, na 150 dem bi. Na dis pipol bi Benjamin shidren-shidren.


E born seven sons and three dotas.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka