Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 127:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 E dey yuzles to work hard from morning go rish nite, bikos of wetin yu go chop. Yes! God dey provide for di pipol wey E love, even wen dem dey sleep.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 127:2
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Pipol wey dey work hard, dey sleep well for nite; weda dem chop small or plenty food. But pipol wey too rish, nor dey even fit sleep at-all.


I dey sleep with peace, bikos na only Yu wey bi my God, dey save mi.


Bikos wi get hope, yor life go dey well; God go protet and give yu rest.


I dey rest, sleep and wake-up well, bikos God dey protet mi.


Den pipol go sey, ‘Wi sleep in peace and wake-up in peace.’ ”


“I go make kovenant wey go guide and protet dem. I go distroy all di wiked animals for di land, so dat my sheep go fit stay for peace as dem dey di field and forest.


As I tink about evritin wey human being dey do for dis world, I kon sey: Evritin dey yuzles; e just bi like sey pesin dey porshu breeze.


Pipol dey work just bikos of wetin dem go chop, but dem still nor dey beleful.


E get one man wey dey stay alone, e nor get pikin or broda, but e dey work hard to get more propaty. But e ask ensef, “Na who I dey work for sef wey make mi nor dey fit enjoy mysef?” All dis tins dey yuzles well-well o-o!


Naw, make Yu save yor pipol wey Yu love. Make Yu ansa kon save us with yor pawa.


Wen God bless pesin, e dey get enough and nor-tin go make am regret.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka