Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 127:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Unless God build house, di pipol wey dey build am, just dey waste dia time. Unless God guide town, doz wey dey guide am, nor go fit protet am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 127:1
35 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Pesin fit make en own plan, but na God dey direct anytin wey e go do.


Pesin wey plant and di one wey wota, nor mean anytin, bikos na God dey make di seed grow.


Make Israel pipol sey, “If to sey Oga God nor dey awa side?”


Jerusalem pipol, I go put pipol wey go dey guide una walls and dem nor go kwayet both for day and nite. But una wey dey pray give God, make una nor stop at-all.


Yu must know sey God don choose yu to build en temple. Naw, make yu use all yor heart take build am.”


Make una give sign make dem go attack Babilon. Give di guide pawa kon put dem for dia pozishon, den una go hide some men for bush too!’ God don do wetin E sey E go do to Babilon pipol.


David tell Solomon en pikin, “Make yu nor fear, but start di work with strong heart and nor let anytin stop yu. God wey I dey serve, go dey with yu. E nor go abandon yu, but E go stay with yu till yu finish di temple and evritin wey go dey inside.


And if Christ nor raiz-up, den awa prishin and una faith nor mean anytin.


I go look up to di mountin! Where my help from dey kom?


My God wey dey heaven, na Yu I dey depend on.


Wen I dey face trobol, I kry to God and E ansa my prayer.


Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion; nobody go fit bend dem and dem go dey forever.


E build temple wey high like heaven kon strong like di eart, den E put am for der.


E sey, “All di leaders wey suppose warn my pipol, dey blind! Dem nor know anytin. Dem bi like dog wey nor dey bark; dem just liedan dey dream. Make una si as dem like sleep well-well!


I don still notis anoda tin for dis world sey; nor bi who run pass dey always win di race and nor bi di sojas wey strong pass, dey always win di war. Wise pipol dey hongry sometaims and just as pipol wey dey work hard nor dey always get money, na so too pipol wey know book nor dey always get betta life. All dis tins dey happen by shance, as long as yu dey di rite place for di rite time.


Wen God take wi en pipol go back to Zion from Babilon, E bi like sey wi dey dream!


I happy well-well wen dem sey, “Make wi go God house.”


“Na mi wey bi God go protet am, I dey always look and wota am. I dey guide am both for day and nite, so dat nobody go skata am.


Make Yu give Solomon my pikin di heart to take obey evritin wey Yu kommand, about how dem go take build di temple, wey I don gada tins for.”


I dey fear sey make di work wey I do among una, nor waste.


Di guide dem for nite si mi as dem dey waka dey guide di town wall. Dem beat, wound and remove di klot wey I take kover my face.


So wen I si di men wey dey guide for nite, I kon ask dem, “Una si my love?”


Difren messenjas go run go tell Babilon king sey dem don break en town enter from difren korna.


My God, I beg Yu! Make Yu give di king di sense to dey judge well! Always allow di king pikin dey tok wetin dey korrect!


Una must remember di Oga una God, bikos na en dey give pipol di pawa to make money. If una obey am, di kovenant wey E make with una grand-grand papa, E go make am happen for una life.


Jeriko king hear sey some pipol from Israel don kom spy di town,


God keep en promise kon give Solomon wisdom. Peace dey between Hiram and Solomon and dem make agriment with diasef.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka