Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 122:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Israel wey bi God pipol, all en tribes dey go der go woship am. Just as Israel law tok, dem dey kom give God tanks for der.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 122:4
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

For evry year, evry man for Israel go dey celebrate dis three feast: Bread wey nor get yist, Harvest Feast and Shelta Feast. For each feast, evribody must karry gift kom give di Oga una God for di place wey E choose.


Yes! God don choose Jerusalem; E don choose di town as en own


Three times for di year, all doz wey bi man go-go meet di Oga dia God.


Di gate wey raitious pipol dey pass enter, make Yu open am for mi, so dat I go-go inside go tank God.


Instead, E choose Judah tribe and Mount Zion wey E love.


una must bring evritin wey I kommand una: una burnt ofrin; sakrifice ofrin; tithe and vow ofrin kom di place wey God choose as where dem go for woship and honor en name.


but una must woship di Oga una God for where en ensef go choose from among all di tribes and na der una go for honor en name.


Moses kom down from di mountin with di two kommandment stones for en hand. God rite for di two side for di stones.


Just as God kommand Moses, Aaron kon put am for di Kovenant Box front, so dat e go dey save.


“Si, I don take di load komot from una shoulder; I don free una from di heavy work wey una dey do.


So make una sing tanksgivin song as una dey enter en present! Make una enter en temple with tanksgivin. Make una tank and praiz en name.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka