4 True-true, di Pesin wey dey guide Israel nor dey sleep at-all at-all.
Unless God build house, di pipol wey dey build am, just dey waste dia time. Unless God guide town, doz wey dey guide am, nor go fit protet am.
“Na mi wey bi God go protet am, I dey always look and wota am. I dey guide am both for day and nite, so dat nobody go skata am.
But for day and nite, I nor dey sleep bikos I dey try to undastand wetin dey happen for dis world.
Dis na why dem stand for God throne front kon dey serve am for en Temple, both for nite and day time.
For aftanoon, Elijah kon dey laf dem dey sey, “Make una shaut well-well. Afta all, na god e bi, may bi e dey tink or waka go out or travel. May bi e dey sleep and e nid pesin wey go wake-am up.”
Na God bi my lite and my salvashon, so na who I go kon dey fear? Na en dey guide and protet mi from danger, so wetin go make mi dey shake?