Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 12:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Pipol dey lie give each oda; dem just dey deceive demsef.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 12:2
25 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Bikos dis kind pipol nor dey serve awa Oga God Jesus Christ, but na dia belle dem dey kare for. With dia sweet and wayo mout, dem go praiz and deceive pipol wey nor wise.


Dia mout sharp like arrow and na so-so lie full am. Dem dey tok well with dia neighbours, but for dia mind, na trap dem dey set for di pesin.


Dem dey visit mi like sey dem bi my friends, but na wikedness full dia heart and wen dem komot from where I dey, dem go-go spoil mi give evribody.


Na lie-lie full dia mout; dem swear sey dem go tok di trut, but na lie dem just dey lie.


Na curse, lie and to treaten pipol, full dia mout. Na trobol and evil dey dia tongue.


bikos my enemies nor dey tok di trut. Wetin dey hongry dem to do, na to distroy odas; dia troat bi like open grave and na so-so lie-lie words full dia mout.


bikos e get doubol mind and e nor dey stabol for anytin wey e dey do.


Make Yu nor drag mi follow pipol wey dey do wiked; doz wey dey tok like sey dem bi friend to dia neighbour, but dem dey plan bad tins for dem for dia mind.


As una know, wi nor ever try to win una with sweet words. And God na awa witness sey wi nor dey pritend to bi una friends bikos of una money.


Bikos dat time, di yeye vishon or words wey Israel pipol dey tok, nor go dey again.


Pesin wey dey praiz en neighbour anyhow, dey set trap for dem.


Pesin wey dey do aproko nor go fit keep sekret. So make yu run from pesin wey dey tok too mush.


Save and diliver mi from my enemies pawa, bikos na lie-lie full dia mout and even doh dem swear sey dem go tok trut, na lie dem still dey tok.


Dem dey spend all dia time dey plan how dem go take finish mi. Dem dey happy to lie about mi. Dem dey praiz mi for my present, but for dia heart, dem dey curse mi.


Dia words dey smooth like butter, but dia heart strong like stone. Dia word smooth well-well like pomade, but na dagger dey under dia tongue!


Bikos of di bad-bad tins wey dem dey tok, bikos of di evil wey dey dia lips, make dia own pride, bad mout and lie-lie, trap dem.


From Zebulun: na 50,000 sojas wey karry difren weapon and dem dey ready for war.


Yet, my enemies still dey set trap to kill mi. Pipol wey hate mi dey plan to skata my life and na evriday dem dey plan against mi.


As I dey vex, I kon sey, “Evribody dey lie well-well!”


Some pipol dey tok how dem dey honbol and faithful, but e go hard to find pesin wey really bi like dat.


So tell dem sey: “Dis na nashon wey nor gri obey di Oga dia God or learn from dia wahala. Nobody for der dey good and di pipol nor dey even tok about good tins again.


Betta pipol wey dey fear God, don die komot di eart and e nor get anybody wey dey good and honest for dis eart again. Evribody for di eart dey wait to kill each oda; dem dey set trap dey wait dia brodas for road.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka