16 I go obey yor laws and I nor go forget yor word.
bikos yor law dey sweet and dem dey give mi good advise.
Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand! Si as I love dem well-well!
I dey like to obey God law with my whole mind,
My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu and always remember wetin I sey make yu dey do.
Make Yu let mi follow yor kommand, bikos na der my happiness dey.
I dey waka go like sheep wey waka lost for bush, so make Yu kom find mi, bikos I neva forget yor laws.
Even doh I nor mean anytin at-all to pipol, I nor go fit forget yor kommand.
Even doh my life nor balance at-all, I nor go stop to obey yor kommandment.
I bi like leda bag wey skwiz, bikos e dey where smoke full, yet I neva forget to obey yor kommandment.
Make Yu sorry for mi kon protet mi, so dat I nor go die, bikos na yor law dey make belle sweet mi.
Dia heart dey empty and stupid, but I dey happy for yor kommand.
Instead, e dey always dey happy to obey God kommand and na both for day and nite, e dey study dem.
Just as I dey happy to get propaty, na so too I dey happy to obey di laws wey Yu give us.
‘My God, I won do wetin Yu wont, bikos Yu rite yor laws for my heart.’ ”
I don keep yor word for my heart, so dat I nor go sin against Yu.
Wiked pipol dey won drag mi enter sin, but yor word dey strong for my heart.
Even doh pressure and wahala dey make mi taya, yor kommand still dey make mi happy.
Make Yu si di sofa wey I dey sofa kom save mi, bikos I neva forget yor laws.
My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi, bikos na yor laws dey give mi hope.
Good pipol dey happy wen dem give korrect judgement, but wiked pipol hope dey die.
My Oga God wey dey mighty, anytime Yu dey tok to mi, I dey listin well-well and na joy and happiness full my heart, bikos I bi yor own.